'As woman, shame bin dey make me shave my facial hair'
11 December 2023
Glory Chinemerem Ibe, bin dey 14-year-old wen hair start to dey grow for her face.
Glory explain say di hair for her face start 10 years ago and becos of shame she come dey shave am comot as she bin dey tire for questions from pipo wey bin wan know why she get bear-bear.
“First time wey I first see am, I dey young like dat I come dey shame. I dey always use shaving stick to take shave am off. I find solution I no see I just start to dey love my self.
I no really reason am like that if dem dey tease me for road. I no dey even dey send anybodi I go just dey bone face waka,” Glory tok.
Glory say she dey always shave once in a week becos di facial hair dey bushy and dey itch her.
She explain say she look for solution tire before she just start to dey love herself.
'Pipo make am look like say na disease'
Chinemerem tokdi stigma
"Any time I go market, pipo go dey tease me if I be woman or man, pipo go dey waka come meet me and tell me say dem get solution for di facial hair and e dey embarrassing becos pipo make am look like say na disease.
One of my former friend back den. We go dey comot she go dey tell me say I be fine girl but di tin wey spoil me na my facial hair." Glory tok.
But now, she say she done overcome di shame and don decide to embrace herself for who she be.
Dis days, she dey comfortable with leaving her beards and slaying with am.
"My confidence don high well-well becos if I wake up for morning, wetin I dey do be say, I go look myself for mirror I go say - you be beautiful girl, you dey wonderful, God create you well," she tok.
Wetin be hirsutism?
Sabi pipo dey call dis condition hirsutism
Acording to di UK National Health Service, NHS, hirsutism na wia women get thick, dark hair for dia face, neck, chest, tummy, lower back, buttocks or thighs. E fit dey caused by a medical condition wey fit dey treated.
Wetin dey cause hirsutism?
Hirsutism dey happun becos of one hormones wey dem dey call androgens. E dey happun as di hormones dey increase.
One common cause of hirsutism, na polycystic ovary syndrome (PCOS) condition, e dey affect di ovaries wey dey also cause, fertility issues, pimples, and irregular menstruation.
Oda causes like adrena tumors and anabolic steroids dey also cause di condition.
How you fit treat di condition?
If you dey live wit hirsutism, you fit begin weight lost journey to reduce di symptoms and control your hormone levels.
Also, you fit dey remove di unwanted hair (shaving, waving, plucking and hair removal) to maintain di hair appearance for your bodi.
Wit di directive of medical doctor, oda tins also dey medically to help control di growth.
Contraceptive pill fit help reduce di excessive growth as e go control di hormones level.
Laser hair removal and electrolysis under professional medical examination na oda alternatives to treat di condition, but e too dey cost and get oda health risks.
Video by Monday Idara